Tuesday, April 9, 2024

SCHOOL NO BE SCAM

 

Google photos 

My people my people!!!!

See ehh, make I tell una something ehh, school no be scam. All these people for social media wey go dey tell you say school na scam no like you o. E no go help you at all o. You wan know? Oya sit down make i gist you.

Normal normal when you Dey school, you go like to pass exam well well so that you go fit get good job. I know say Nigeria don spoil finish so if person comot school, do NYSC finish, you fit no see job unless you get connections. Honestly I understand because na connections dey save many people for this country if not many people for don die of hunger. Normally every body for this country suppose get job as long as you good for your profession but corruption don make everywhere for naija to rotten. Na so so wuru wuru and 419 many people dey do nowadays for naija.

So I understand why some people no dey gree say school no good because education dey bad for naija too much. Teachers no Dey get better money,students no dey get opportunities and politicians no dey reward children wey dey do well for WAEC and JAMB,even that Cowbell competition that year. Them no dey even do am again sef,chai Nigeria🤦🏾‍♀️

But you see ehh,my brothers and sisters,because say naija don spoil no mean say you no go value basic education not to talk of further one. Even to express yourself and to think properly,that one too sef dey. When you Dey use social media especially for Twitter (X) app ehh,e get plenty conversations wey you fit participate because you no say you go fit contribute to am. No dey see school like say na only because you wan make money na why you dey go school. School suppose set foundation for you to even see life.

School go fit help you even for your personal life and sometimes na that knowledge go even give you money. Them dey call am ‘financial literacy’. Even that your school result fit help you for outside naija. I know say sometimes oyibo no dey trust African graduates but if the abroad wey you go,them give you chance to defend your result,you go fit explain yourself,no be so? No be English you go speak sef,ehe you see na. They wan make sure say you go get communication skills before you go begin explain your thesis make them make sure say you dey think ahead. Them dey call that one, futuristic.

Make I even tell you the main thing wey inspire me to write this topic. Na health matter. Me wey dey tell you this one ehh,I do chemistry for secondary school and I even write am for my WAEC and JAMB. I remember when dem teach us about chemical reaction of all these different different chemicals wey we dey see for lab. Chemistry students if una dey read,I no say una go sabi wetin dem dey call base,acid,titration and all those their grammar that year. I remember say when I Dey take some kind drinks like coke,Fanta and sprite,I Dey enjoy them. I know say them get gas so I no dey combine them with certain things especially if I Dey on drugs or I wan lick peppermint sweet. I no dey even take candy and drugs immediately. You know why? The gas wey dey for that drink/soda (any one) fit chemically react to the drugs and that thing fit kill person.

Ok what of the peppermint sef. You know say mint get one chemical wey them dey call menthol. When you taste am,e go be like say something dey cold for your mouth but later you go notice say if you get cough or catarrh,e go dey comot small small. E dey for butter mint sweet,baba blue and lemon plus. From this one wey I mention,you go find other sweet wey get that similar feeling wey these ones dey give you. Another thing be say,e get one plant dem dey call mint. Mint na herb just like bitter leaf,scent leaf or water leaf. E dey very healthy and people dey use an for many things including sweet and even drug. Why e no good to take mint sweet with drug or soda na because of those chemicals including that menthol wey dem don mix with am. Na that time,the thing go dey dangerous. I no be medical doctor or lab scientist or environmentalist but I sabi this one,why? Because I go school. Otherwise I no know where I for dey today. If you no sure about wetin I talk,you for go research for internet.

Some of una get doctor friends,even scientist friends. Try Dey ask them question so they una go discuss these things. The fact say you fit read an for internet na because say you go school so that one na advantage. Na because we go school,na why we know say drug abuse no good. If you Dey read this blog,Abeg no joke with school o,e go help you if not today,then in future. You fit acquire knowledge wey go help you find another knowledge wey go help you change society too. Even if you no dey think of this one now,at least your life dey important and na lack of basic knowledge dey kill people. Trust me I don see am too many times and I don tire to go dey see people dey perish because of lack of knowledge,even baba God talk am.

My brother,my sister,go school.

Ignorance no be bliss,na correct disease wey dey kill!!!!












No comments:

Post a Comment

TASTY IGBO DISHES

Growing up as an Igbo girl gave me the golden opportunity to savour lots of dishes. Whether at home, restaurants or even at occasions rangin...